Tatafo Headquarter

See Wetin Husband Do Wife Wey Use Children School Fees Buy New Hair

Na inside Odibo this morning Clement phone ring as he wan dey go work. When he check, na school principal dey call.  As Clement pick, the principal first greet am, then ask how e dey and if everything dey okay, because he surprise say na 3rd week since school don resume yet Clement never still pay him two children school fees — something wey no be Clement character at all.

The matter shock Clement because before now, he don already give him wife the full money for the school fees. But as principal talk finish, Clement reason am say something no pure.

Na so Clement confront he wife, only to discover say instead of madam to pay the children school-fees, she use am take add buy Pixel Curl hair.

 

The thing vex Clement well well. Out of anger, he land the woman two heavy slaps and tell her straight say until she bring back that ₦90,000, she nor go step leg enter the house again.

At the time of this report, Clement wife don reach Robinson plaza to sell her phone to save her Marriage.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

error: Content is protected !!