Tatafo Headquarter

CONFRA GUY WEY WAN PROVE SUPER-MAN FOR HE BABE DON LEGGO FOR UGHELLI

Wetin suppose be ordinary charger head matter don kpai one guy yesterday evening for Ughelli.

Story be say, Fejiro girlfriend, Ewoma carry her phone go charge for one barbing saloon. When she return, she notice say person don swap her charger head. She begin para and suspect one guy wey dey charge phone there.

Na so argument start, the guy vex give Ewoma correct slap. Ewoma nor gree, she rush report the matter give her boyfriend Fejiro wey be confra.

Fejiro hear matter, recognize the guy by description, he waka go confront am. From small talk na so gbas gbos burst!

 

Wetin Fejiro nor know be say the guy crew dey ground. Before he fit do anything, dem don bracket Fejiro, beat am scatter, and use dagger plus axe burst he head.

Fejiro leggo on the spot.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *