Tatafo Headquarter

6 Weeks After Benson Open New House For Jeddo, See How God Take Suprise Am

Wetin suppose be normal travel almost turn RIP yesterday, but Baba God show mercy!

Benson, one young guy from Jeddo wey just open him new house six weeks ago, narrowly escape death yesterday as he dey travel from Kogi come Warri.

According to reports, Benson dey return from him village when one of the car tyres suddenly burst. Na so the motor begin somersault anyhow before e jam tree scatter.

People wey rush go the scene believe say na finish for am be that. Some even talk say Benson don kpuff already. But he come out alive without any scratch.

Eyewitnesses talk say the impact of the crash heavy well well and nobody believe say human being fit survive that kind accident. Many people rededicate their live to Jesus on the spot.

Benson talk say he know say if no be God, na him obituary people for dey read today. This accident na proof say miracle still dey happen.

Glory be to God!

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *