Tatafo Headquarter

Young Boy Wey Dey Always Wake Neighbours With Iĝbø Smell, Kpuff This Morning

Na this morning one young Warri boy wey dem dey call Philip kpuff unexpectedly as he dey blow cana for backyard of their compound for Igbudu.

According to people wey sabi am, Philip be na very intelligent and promising boy. But ever since e mama kpai when he dey SS2, life take another turn for am.

The quiet, gentle Philip wey nor dey near smoke or drink, suddenly turn another person — smoking, drinking, and living like who evil spirit don enter.

Dem say the thing come bad reach point where Philip no fit chop food until he don first burn igbo for morning. Reports even talk say sometimes, na 7 wraps a day he dey finish, without eating better food.

Early this morning, as e dey smoke for backyard, Philip suddenly collapse and begin vibrate. Before neighbours fit rush am go hospital, life don waka comot for him body. Philip na just 29 years old.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *