Community crisis for Umuahia don kpuff one correct Naija man wey dey base for Vietnam. The man name na Samson Nwaubani and he just recently returned from abroad to Enjoy New Yam festival.
Na one small argument between one person from Umuajata and another person from Okwu come turn to big gbas gbos.

According to reports, the matter come heavy when the youths from Okwu carry vex enter Umuajata community go scatter people property.
So on the New Yam festival day proper, as Samson and some of di Okwu boys dey waka pass Umuajata dey go where di party dey, wahala come burst.
One person wey see wetin happen talk say di boys from Umuajata don already lay ambush for them. As dem jam, another heavy vawulence come start.
Na inside dis gbege dem come chook Samson knife and he slump for ground kpuff. People dey suspect sau foul play and jealous dey over the kpuffing of Samson but only God knows.
Leave a Reply