Tatafo Headquarter

Innocent Girl Dey Battle For Life After Confra Guys Find Her Boyfriend Come House

Na serous gbege play out for Oleh-Irri Road, Isoko South L.G.A this afternoon. According to reports, heavy confra clash between two rival groups na cause the kasala.

We dey get reports say serious injuries don happen, and di whole place don turn to battleground.

According to our reporter, some of the confra boys carry dangerous tools go find one of their rival for house, but they no see am. Instead, they see the guy girlfriend.

Instead of the confra guys to leave the innocent girl, them chook her body yangaga before them run comot the house. As e be now, the innocent girl dey battle for life for undisclosed private hospital

Voice of Warri dey monitor di situation. We go give una more updates as we confirm dem. For now, please, make una avoid that area and dey safe.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *