Tatafo Headquarter

See Wetin Itsekiri Youths Do Uhrobo Man Wey Enter Itsekiri Community Go Do Bad Thing

This Sunday afternoon for Ugbori community, Warri South LGA, turn another level as one Urhobo guy wey dem identify as Tega jam gbege after dem catch am say he break enter person house go thief.

According to our reporter wey see the matter, Itsekiri youths catch Tega as he dey try thief for person house. But instead make dem beat am anyhow or carry out Jungle Justice, itsekeri youths show kindness by not taking laws into their hands.

After questioning, Tega confess say he be confirm omila. The youths come hand am over to police make dem handle the case wella.

People for the area hail the Itsekiri youths for the way dem take manage the matter, especially as both tribes don dey get small-small wahala recently.

The action show say peace still fit dey and unity still dey possible between Itsekiri and Urhobo people.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

error: Content is protected !!