Information wey reach Voice of Warri studio from Ghana don scatter many heads for town — dem say one of our own Warri boy, Austin, don leggo for Ghana under very sad circumstance.
According to the tori, Austin no be small boy for street. Before, e dey stay Cinema Site, Warri, where e dey always ginger boys with big dream say “Na abroad money dey.” Around three years ago, e pack go Ghana with the hope say e go blow for yahoo hustle and turn big man.
At first, everything sweet. Our reporter yarn say Austin pick over ₦12 million last year. Money just dey rush in like say na pure water. E begin live big — new phone, designer wears, babes full everywhere, and every weekend na club and flex. The boy even buy car wey e use do shakara for social media.
But as e be say money no get root if you nor wise, the story change. After e blow finish, maga dry up. E no pick again, even when e try every kind level — from spiritual runs to juju backup, e still no see alert. E go from enjoying Ghana life to borrowing data and managing one plate of rice a day.
The pressure and frustration begin weigh am down. People wey chop with am before begin dodge calls. Friends turn ghost. Babe wey e carry for house waka leave am. Na so depression enter body.
Our source talk say Austin don dey quiet for some days now, and this early morning, neighbors hear noise for him room. When dem rush enter, na sniper bottle dem see for ground, and Austin dey cry dey roll for ground. They rush am go hospital but he leggo.










Leave a Reply