For the past couple of months, Agbarho don dey witness strange cases of plenty missing children for the town, wey dey make many people worry.
But this morning, hand touch one young guy wey dey share ₦1000 notes each give small small primary school children.
According to our reporter, one teacher sight the young boy as he dey share ₦1000 each give the children. Na she ask the guy why he dey share money for them. The guy nor talk anything.
She come ask am make he give her the money so she go do the sharing herself, but the guy nor gree. He talk say he nor dey give adult he money to touch — na only children, because adults get evil mind.
The teacher suspect foul play, na she raise alarm. Na so task force show and carry the young guy go for questioning.
People wey know the guy wey dey share ₦1000 each talk say he family dey hungry, but he still dey dash money. Dem suspect say the sharing nor be ordinary — na ritual matter.










Leave a Reply