Tatafo Headquarter

Dangerous Keke Riders Wey Dey Put Jas For Mouth Dey Town – Children Na Their Target

Reports don reach Voice of Warri say some evil keke dey move around town especially Estate side.

These dangerous keke riders go carry only one passenger for back and the driver plus him padi go dey use jas for mouth take hypnotise children wey dey come back from school.

Their mission na to hypnotise the pikin make he run house go carry wrapper, money, phone and any valueable thing come give dem.

Some people don fall victim alredy. This na serious warning to all parents:

  1. Talk to your child or children make dem no enter anyhow keke especially if the keke rider say he go carry dem for FREE.
  2. If you get pikin wey dey Jss3 to Sss3 warn am make he nor chook mouth for any matter about money, gold or diamond for inside keke.
  3. Teach dem say stranger no be friend.
  4. Always pray over your child or children  before he go school.

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

error: Content is protected !!